Di news say Nigerian President Bola Tinubu, on Thursday grant pardon to plenty Nigerians – some wey don die – don spread like wild fire.
Di tori don start ogbonge tok-tok especially among young pipo for di kontri.
Some dey wonder why somebodi like Herbert Macaulay, wey be one of Nigeria founding fathers wey don die many years ago, go even need presidential pardon.
While for odas, di recent case of Farouk Lawan wey court send to prison for collecting bribe, still dey fresh for dia memory and dem feel say dis pardon look like reward for bad behaviour.
Di list include plenty oda names of regular Nigerians wey pipo no too know, like one Nweke Francis Chibueze, wey dey serve life imprisonment sake of say e carry cocaine, and Nwogu Peters, wey don serve 12 years for inside im 17 years prison sentence for 419 offence.
However, di presidency tok say di individuals wey Tinubu grant pardon don “demonstrate sufficient remorse”, so di pardon na “to allow dem to integrate into society”.
Some of di popular names for di list, wetin be dia offence?